Skip to main content

Daddy Showkey Blasts Imo Governor, Calls Out APC-Led Administration.


Veteran singer, Daddy Showkey has via a lengthy post on his Instagram page called out the Imo state Governor, Rochas Okorocha over Jacob Zuma’s statue that has generated lots of controversy.


He wrote:

    My people make me una hear, this one surprise me oo
    What is it that when someone wants to contest for a seat in the government concerning someone in power,that is when the person in power will be using the government’s might to dugout the past of the person who wishes to contest for that position. And these same people was used by the person in power when you were campaigning for your seat in power. If you knew that they were bad, y use them in first place. Now for the same government , sombodi dey build statue wey e no concern the country at all. Abi una don hear say dem build Sam Mbakwe statue for South Africa? Wey be the father of Imo state. Imo people dey suffer, he dey build statue wey e no concern the power. For the same government, ministers say dem give contract, government say dem no give contract(NNPC) the minister house catch fire burn.
    For the same government road no dey to reach the only international port wey we get for Nigeria. People wey dey import goods no fit carry their goods after clearing comot from port… for days, for weeks, for months (Wharf Apapa port, tincan) . Na Ajegunle people dey suffer because trailers don block all the road wey Enter Ajegunle and Apapa G.r.a.(wey be one of the most beautiful g.r.a before when we dey grow up,we dey call am European quarter)
    Today,no road because all our bridge trailer don block am finish on top ijora bridge. Until the day when the bridge collapses and kill people na him dem go talk.
    Now wayo Rochas dey build statue wey e no concern him people, him government workers wey him never pay money. Since when him dey as governor, local government election him no do. Nobody talk anything,sidon(sit-down)look na dog name. My people we go dey Sidon look? If we talk,dem go go dig our past.
    Me as one person,I don tell una before day for the streets of Ajegunle dem born me. If u like go dig my past because I don tell the world about my past before and I dey bold to talk about my past. How many of una fit do am,now Nigeria Na our own, Na the people own, Na One Nigeria. East-west-North and south, our people dey suffer.
    We dey look una oo and we go soon ready for una #showdonshow #daddyshowkey #lionclan #ajegunle

Comments

Popular posts from this blog

New Release: Oladele Akinkunmi (kunmesco) officially dropped latest single TOP GUYZ

Hottest and Baddest artist in town Kunmesco   officially dropped latest single titled TOP GUYZ .. Bio about Kunmesco What's your full name   Oladele Akinkunmi How long have you being in the music industry 5years and still counting What inspire the music Top Guys    I got friends and families around me, that cheer up and support me and to all my fans out there that loves and keep supporting me... This song is dedicated to everyone... Download & listen to TOP GUYS by KUNMESCO   https://sites.google.com/site/ogboluifeanyit/ogboluifeanyit/KUNMESCO_TOP%20GUYS.mp3?attredirects=0&d=1   For bookings and enquiry Kindly contact   08167568680 and email @ oladeleakinkunmi1 @gmail.com

Facebook user Nthabiseng matlou went nude to celebrate her birthday +18

She's looks so beautiful .. But for this her Facebook friends reacted to her post in various ways

Facebook Prince of the week- Ebimobowei Joshua Agai

If u don't know this Nigeria/bayelsa top model.... Hmm ... He's a top celebrity and one of the best make up artist in Nigeria.. More picture Our Facebook prince of the week Joshua agai